Hot topics close

Arsenal vs Southampton highlights: How Gunners come from behind ...

Arsenal vs Southampton highlights How Gunners come from behind
Arsenal kwanta wit Southampton for di Emirate stadium. Di Gunners bin dey hope to extend dia lead for di Premier League table as dem continue dia title chase.
Bukayo Saka

Wia dis foto come from,

21 April 2023

Arsenal drop points for a third time in a row afta dem draw 3-3 with Southampton for di Emirates.

Di Gunners come from two goals down to draw level with Southampton.

Di chance to win di title dis season don continue to dey slim for Arsenal wey get Ogbonge Manchester City wey dey pursue dem bumper to bumper with two outstanding matches.

Arsenal still dey top of di table for now with 75 points.

Dem go play Manchester City next Wednesday.

Di match as e happun live Second Half

Full Time Arsenal 3-3 Southampton

90+11 Referee blow im whistle, match don end.

90+10' Gabriel Jesus of Arsenal fall afta one defender challenge am but Referee no dey interested for di penalty wey dem want.

90+9' Thomas Partey of Arsenal try im luck as im shoot from far but di shot too weak as di ball go over di bar.

90+6 Reiss Nelson of Arsenal fire shot inside si box but Southampton defender block am.

90+5 Gabriel Jesus of Arsenl fall down inside di box afta one defender challenge am, but Referee continue play.

90+4 Ibrahim Diallo of Southampton collect Yellow Card afta e bring down im opponent.

90+1 Na 8 minutes of added time Referee give.

90' Arsenal 3-3 Southampton

90' Goal! Bukayo Saka fire one rebound into di botton right corner of di net

88' Arsenal 2-3 Southampton

88' Goal! Martin Odegaard of Arsenal pick di ball from di edge of di box, na so so im fire shot into di left side of goal.

86' Substitution for Southampton, Ibrahima Diallo go replace Romeo Lavia.

85' Substitution, Mikel Arteta wey be Arsenal coach wan bring in fresh legs. Reiss Nelson dey replace Gabriel Martinelli

84' Bukayo Saka pass one sweet cross into di area but Gavin Bazunu block am.

80' Bukayo Saka ply di corner kick but dem block am, na Gabriel Jesus bin play di ball into di box but Southmpton defenders clear am go corner kick.

77' Substitution for Southampton, Paul Onuachu don enta for Theo Walcott

77' Substitution for Southampton , Adm Armstrong don comot, Kamaldeen Sulemana replace am.

76' Adam Armstrong don collect Yellow Card for foul.

72' Substitution for Arsenal Eddie Nketiah don enta for Oleksandr Zinchenko.

69’ Gabriel Jesus of Arsenal run enta di box to try reach one cross, im direct di ball wit shot towards di goal but e go over di bar!

67' Arsenal 1-3 Southampton

67' Goal! Duje Caleta-Car of Southampton beat di Goalkeeper wit im effort! James Ward-Prowse of Southampton bin deliver di ball into di box from corner.

65' Romeo Lavia neva get any injury wey make am comot from pitch, im don enta di game back.

64' E be like say Romeo Lavia of Southampton dey struggle afta dem knock am, hopfully im fit manage am.

63' E be like Arsenal dey enjoy di game s dem dey play short short passes as dem dey wait for Southampton defence to open.

61' Southampton clear di ball afta Gabriel Jesus of Arsenal try to dripple pass im opponents.

57' Substitution for Arsenal, Leandro Trossard don enta for Fabio Viera.

56' Gabriel Martinelli play di corner kick wit short pass.

55' Cross from Bukayo Saka of Arsenal no reach di box as Southampton defence clear am. Arsenal win corner kick.

54' Southampton defence tanda gidigba as dem clear one dangerous cross from Gabriel Martinelli of Arsenal.

51' Kyle Walker-Peters of Southampton try to create chance but di power e put for di pass too much.

49' Ben White of esenal send one beta cross into di penalty area but dem block am.

46' Substitution for Southampton, Lyanco dey repalce Carlos Jonas Alcaraz.

46' Second half don start with Referee whistle

William Saliba neva play for Arsenal since im comot by force from field against Sporting for di Europa League on 16 March

Wia dis foto come from,

First Half

Arsenal 1-2 Southampton.

45+8' Simon Hooper don blow whistle, First Half don end

45+8' Gabriel Jesus of Arsenal miss chnce to score, e see small space inside di box na so im strike ,but Southmpton defend balance well t defend di goal.

45+4' Simon Hooper don give Oleksandr Zinchenko Yellow Card for foul.

45+3 Ben White hed di ball as e dey come from di corner kick but dem block im header.

45+3'Bukayo Saka go take Arsenal corner kick.

45+1'Gabriel Jesus of Arsenal shoot from di edge of di penalty area. Di ball land near di middle of di target but Gavin Bazunu clear di threat go corner kick.

45+1 Referee give 7 minutes of added time

42'Kyle Walker-Peters of Southampton don collect Yellow Card

41' Substitution for Southampton, Duje Caleta -Car don replace Jan Bednarek wey don get injury

37' Jan Bednarek of Southampton dey in pain, di physio dey treat am afta referee call am to come di pitch.

36' Gabriel Martinelli of Arsenal play di ball into di penalty area, but Southampton defence tanda for ground, dem just clear di ball.

33' Almost! Fabio Viera of Arsenal curl di ball from di edge of di box but e bend go eide off di post.

32' Roman Perraud of Southampton dob collect Yellow Card for foul play.

31’E be like say Theo Walcott go fit play o

29’ Theo Walcott of Southampton don get injury but we neva know how serius e be.

29’ Marin Odegard miss one beat chance as e head di ball from near di penalty spot but e go over di bar.

27’Carlos Jonas Alcaraz don collect Yellow Card for bad tackle on im opponent.

26’ Carlos Jonas Alcaraz of Southampton drive one shot towards di right side of from inside di box goal, but Aaron Ramsdale kick am comot.

23'Ben White of Arsenal cross one beta ball into di penalty area, but Southampton defender clear di ball.

20' Arsenal 1-2 Southampton

20' Goal! Gabriel Martinelli of Arsenal don pull one back.

14' Arsenal 0-2 Southampton

13’ Goal! Carlos Jonas Alcaraz of Southampton play one pass go Theo Walcott leg and im shot am into di bottom left corner from inside di box.11' Arsenal dey play short short passes to try drw Southampton come out but e neva work.

8' Oleksandr Zinchenko take one quick shot from di edge of di box afta a rebound but di ball go over di bar.

6' Fabio Viera of Arsenal cross one beta ball into di box but Southampton clear am go corner kick.

Arsenal 0-1 Southampton

1'Carlos Jonas Alcaraz of Southampton get di ball by di edge of di box afta one big mistake wey Arsenal make. E fire di ball into di back of di net.

1' Referee don blow whistle, match don start.

Arteta speak before di game

"Wetin we dey play for na sometin incredible," Arteta tok. "Di club neva fight for dis position for a very long time.

"E dey our hands now. We want to do am."

"I dey very confident," Arteta continue to tok. "Twists and turns na part of anytin you do, especially for football.

"Whatever di aim or di target be, e no go go in a linear progression. You need to know and prepare for am.

"Maybe we dey too comfortable at some stage wit (West Ham) game. I no need to coach dem because dem tok am straight away.

"Dem know, e dey dia system, e dey dia gut and we get to show am."

Team News Match Facts

Head-to-head

Arsenal bin dey unbeaten for 27 top-flight home matches against Southampton (W19, D8), one less dan dia longest run against a particular opponent (ongoing versus Fulham since 1949).

Saints bin don win just two of 45 league fixtures away to di Gunners (D15, L28), victories at Highbury in 1968 and 1987.

Di Gunners bin don win 11 of dia past 12 home league games versus teams wey dey start, wey dey bottom of di table, dem only drop points for one goalless draw against Burnley for January 2022.

Southampton

Di Saints bin don only get three points from dia 15 Premier League games dis season versus teams wey currently dey di top half of di table (D3, L12), though e include one 1-1 draw wit Arsenal for di reverse fixture.

Dem bin don lose dia six most recent top-flight matches away to sides wey dey start on top of di table, wit dia last such victory wey happun for Liverpool for September 2013.

Saints neva win any match for six league games (D2, L4) dem neva get clean sheet in each of dia last five matches.

Line Up

Arsenal: Ramsdale, White, Holding, Gabriel, Zinchenko, Ødegaard, Partey, Fábio Vieira, Saka, Gabriel Jesus, Martinelli

Southampton: Bazunu, Walker-Peters, Bednarek, Bella-Kotchap, Perraud, Alcaraz, Ward-Prowse, Lavia, Elyounoussi, Walcott, A Armstrong

Similar shots
News Archive
  • Shiba inu coin
    Shiba inu coin
    Shiba inu's dogecoin-beating rally ranks it among the top 20 coins
    7 Oct 2021
    2
  • Mineral Resources
    Mineral Resources
    Resort-style FIFO camp plans for Onslow divide opinion as Mineral Resources pushes ahead
    7 Dec 2022
    2
  • New in Town
    New in Town
    NEW IN TOWN: First Filipino store in Cambridge, a new salon and ...
    21 Jan 2023
    1
  • Pink concert
    Pink concert
    Countdown is on for Pink's Townsville concerts Townsville City ...
    4 Mar 2024
    1
  • Millie Gibson
    Millie Gibson
    Millie Gibson revealed as Time Lord's new sidekick in Doctor Who
    19 Nov 2022
    1
This week's most popular shots